Nigeria dey mourn afta dem bury popular cleric Dahiru Bauchi
Presido Tinubu dey tell all di Sheikh followers for inside and outside Nigeria say make dem take heart for dis big loss wey nobody go fit replace.
Plenty pipo for Nigeria still dey mourn di death of Islamic cleric Dahiru Bauchi wey dem bury on Friday.
Presido for Nigeria, Bola Tinubu hear say e dey very sad afta e hear about di death. E dey feel the loss well well.
The ogbonge cleric wey dey Bauchi, for north east Nigeria die for Thursday, e bin reach 101 years.
Presido dey mourn am, e dey talk say na im be like moral compass wey use im whole life dey teach and dey preach.
Presido Tinubu talk say Sheikh Bauchi death no be small thing, e affect not only im family and all im plenty followers, but na big loss for di whole kontri.
Presido dey remember all di blessings and moral support wey di late Sheikh Dahiru Bauchi give am for di time wey e dey run for di 2023 election.
"Sheikh Dahiru Bauchi na teacher, na father, and im dey always talk sense and dey call for calm. As im dey preach and as im sabi di Holy Quran well well, na person wey dey always preach peace and to fear God. Im death don leave one big space wey nobody go fit fill," di Presido talk.
Presido Tinubu dey tell all di Sheikh followers for inside and outside Nigeria say make dem take heart for dis big loss wey nobody go fit replace.
E dey also beg dem make dem no forget di late cleric by holding to wetin im teach dem: to dey live in peace with everybody, to dey closer to God, and to dey show love to all people.