| Pidgin
WORLD
2 minit wey yu go read
50 house don burn, 20 pipo dey hospital afta explosion rock Eleme for Rivers
Di incident wey happen Thursday, happen around 5pm and e come from one pipeline wey belong to Nigeria Gas Company wey allegedly burst.
50 house don burn, 20 pipo dey hospital afta explosion rock Eleme for Rivers
Di injured dey receive treatment

About 20 pipo don wound and over 50 house don burn down following explosion of gas pipeline for Aleto community, Eleme Local Government Area of Rivers State.


Di incident wey happen Thursday, happen around 5pm and e come from one pipeline wey belong to Nigeria Gas Company wey allegedly burst along Old Bori Road for Aleto.

One source wey be resident of di area talk say: "Di pipeline don cause injuries and damage properties. Dis pipeline don dey leak for about three weeks before di explosion today."


Di source wey give im name as Emmanuel talk say some leaders of di area don notify di company about di leak but di company no respond well.


Leader of di Eleme Legislative Council, Daniel Chuma, talk say im don write to di company about di leak and follow up with petition to relevant authorities but nothing concrete no happen to stop di gas leak.


Chuma wey visit di scene of di explosion talk say: "There was leakage on another section of di Nigeria Gas Company. We write to dem, and we do petition to NOSDRA and Rivers State Ministry of Environment and copy Police for urgent intervention.


"We ask for joint investigation. We no know wetin dem do before dem leave. Today dem call us to explosion for di same pipeline of di Nigeria Gas Company wey don destroy over 50 houses, cars, and many casualties. Dem don rush pipo to hospital.


"Before now, everybody run for safety. Di few wey come, we ask dem to stay far away to avoid any further incident."


Meanwhile, di Executive Director of di Youths and Environmental Advocacy Centre, YEAC-Nigeria, Dr Fyneface Dumnamene, for one statement, confirm di development.


Fyneface talk say: "We dey use dis medium to call on di relevant authorities, di Rivers State government, Ministry of Environment, NOSDRA, di Rivers State, di Federal Government, and all di bodies wey dey check oil spill and explosion to come help Aleto pipo. Dis na serious incident."