| Pidgin
POLITICS
2 minit wey yu go read
President tok say Nigeria go review how dem dey fight terrorism
Di presido hold meeting wit im service chiefs and dem talk how to handle di new attacks wey dey happen for some pats of di kontri.
President tok say Nigeria go review how dem dey fight terrorism
National security adviser Nuhu Raibadu also tanda for di meeting / Reuters
6 hours ago

President Bola Tinubu don give order to di army go buy new military equipment, as part of di plan to change how dem dey fight di terrorists and bandits wey dey give Nigeria wahala.

Yesterday, di President hold meeting wit im service chiefs for inside Aso Rock. Di meeting last good two hours, and dem talk how to handle di new attacks wey dey happen for some pats of di kontri.

Di meeting come just one day after di Minister of Defence, Gen. Christopher Musa (rtd.), call all di service chiefs because terrorists don overrun more dan three military bases for North-East for less dan one week.

Dis one na di first meeting since Tunji Disu become IGP, and inside di meeting, Tinubu give di army order make dem quickly buy more equipment to strengthen di operation against terrorists and bandits.

According to di Defence Minister, dem look di security mata for di whole kontri well-well, especially di attacks wey dey happen for North-East, most especially Borno State. Musa tok say di army and oda security agencies don already change dia tactics to face di new ways wey di insurgents dey use fight.

Doz wey attend di meeting na di National Security Adviser (NSA), Nuhu Ribadu; di Chief of Defence Staff, Gen. Olufemi Oluyede; di Chief of Army Staff, Lt. Gen. Waidi Shaibu; di Chief of Naval Staff, Vice Admiral Idi Abbas; and di Chief of Air Staff, Air Marshal Sunday Kelvin Aneke.

Oda people for di meeting na di Chief of Defence Intelligence, Lt. Gen. Emmanuel Undiandeye; DG of DSS, Oluwatosin Ajayi; DG of NIA, Mohammed Mohammed; and di IGP, Tunji Disu.

Musa tell journalists afta di meeting say: "Di meeting na to make all di security heads tell Mr President wetin dey happen for ground. You know say some attacks don happen, but di security forces don stand up well-well to handle am."