Nigeria Presido don extend shea nut export ban
Di extension wey go start from February 26, 2026 go end February 25, 2027, na to make Nigeria to fit to process shea nut for inside di kontri.
President Bola Tinubu of Nigeria don give approval make di ban wey dey on exportation of raw shea nut extend anoda one year.
Dis one na to show say di federal government still dey push make Nigeria dey process di goods for inside di kontri before to sell go outside.
Di president spokesperson, Bayo Onanuga, tok about dis mata for statement wey im release on Wednesday. According to di statement, dis decision follow di government plan wey dem dey call "Renewed Hope Agenda," and e show say dem want make Nigeria stand well-well for global market.
Di statement tok say: "President Bola Ahmed Tinubu don approve di ban on raw shea nut export for anoda one year, starting from February 26, 2026, go reach February 25, 2027."
Di extension wey go start from February 26, 2026 go end February 25, 2027, na to make dem fit process shea nut for inside, make life better for di pipo wey dey produce shea nut, and make dem dey sell finished goods rather than raw materials.
Last year for August, Mr. Tinubu don first sign six months ban on raw shea nut export. E do am to stop di way pipo dey carry am go outside anyhow.
Dat time, di ban start work immediately, and di main target na to boost shea business for Nigeria, so di kontri fit dey make around $300 million every year for short time.
Di government don tok before say, even though Nigeria dey produce almost 40 percent of all di shea wey dey for global market, dem still dey get only 1 percent of di $6.5 billion market.