| Pidgin
WORLD
2 minit wey yu go read
Nigerian Army scatter ambush for Cross River, kill four gunmen
According to di statement, di matter happen on March 12, 2026, afta di soldiers hear say fight don dey brew for Odonget Community sake of land mata.
Nigerian Army scatter ambush for Cross River, kill four gunmen
Di Army reapond sharpaly after dem hear of foght / Reuters
12 hours ago

Di soldiers of 13 Brigade, Nigerian Army don scatter attack wey some bad boys plan for dem, as dem dey go settle fight for Odonget Community, Obubra Local Government Area for Cross River State.

Di army tok dis for statement on Thursday, wey Lt. Yemi Sokoya, wey be di Major Assistant Director, Army Public Relations for Headquarters 13 Brigade Nigerian Army, sign.

According to di statement, di matter happen on March 12, 2026, afta di soldiers wey dey for Ochon and Alesi hear say fight don dey brew for Odonget Community sake of land mata.

Sokoya tok say di soldiers "quickly comot make sure tings no spoil" by going to di community, where dem waka up and down show say dem dey dia. Dis one help cool di matter and make peace come back between di two sides.

But as dem dey comot go back to dia base afta don settle di matter, di soldiers see say some pipo don block di road wey dem suppose take pass.

"As dem dey try clear di road, some gunmen wey hide for bush begin shoot dem from everywhere, so di soldiers fire back well-well," di statement tok.

Im add say as di soldiers on ground tell dia oga say dem dey under attack, di 245 Battalion quickly send backup with armored vehicles and oda tins to help fight.

"Di quick response make di soldiers able to scatter di attack and clear di bad boys," Sokoya tok.

Im still tok say afta di fight end, di soldiers find four of di gunmen don die. Dem also recover AK-47 rifle, two magazines wey get 60 rounds of ammunition, one locally made pistol, one double-barrel gun, and some oda dangerous weapons like cutlass and dagger.