| Pidgin
WORLD
2 minit wey yu go read
Fuel wahala for Mali make all schools close down
All di schools for di West Africa kontri go remain shut from October 27 go reach November 9 as transport and daily life dey inside palava.
Fuel wahala for Mali make all schools close down
Pipo gather for petrol station due to shortage of petrol for Bamako, Mali, October 7, 2025. / Reuters / Reuters
27 Oktoba 2025

Mali don suspend all school for di kontri for two weeks sake of fuel wahala wey dey happen now, na wetin di kontri Education Minister tok on Sunday.

Amadou Sy Savane yarn for di state-owned public broadcaster ORTM say all di school dem for di West African kontri go stop activities from October 27 go reach November 9 because of di fuel crisis.

Savane still tok say di schools go reopen back on November 10.

For some weeks now, Mali dey face fuel wahala wey armed groups dey block di road dem wey fuel tankers dey use, and dis one don affect di capital, Bamako well well.

Di wahala don make long queue full for filling stations, public transport and okada dem no fit waka well, and di streets for Bamako wey dey always full don dey quiet pass as e suppose be.

Even di higher institution dem for Bamako don tok say dem no fit continue classes sake of say students and teachers no fit reach di campuses because of di fuel shortage.

Di US Embassy for Bamako announce on October 24 say dem non-essential diplomatic staff and dia family go comot from Mali sake of di fuel wahala and di security concern wey dey grow.

On Friday, di embassy still tok say dem no fit provide routine or emergency consular services outside Bamako and dem still remind people say di travel advisory for Mali still dey active.