| Pidgin
POLITICS
1 minit wey yu go read
EFCC dey investigate suspect wey no declare foreign currencies for Kano airport
For one statement wey dem release on Monday, di anti-graft agency say di currencies wey dem seize include $73,000, £15,957 and 827,800 Saudi Riyals.
EFCC dey investigate suspect wey no declare foreign currencies for Kano airport
EFCC say dem dey investigate di matter

Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) for Nigeria say dem don begin investigation of one Haruna Yusuf over alleged multiple undeclared foreign currencies wey di Nigeria Customs Service (NCS) intercept for Mallam Aminu Kano International Airport.

For one statement wey dem release on Monday, di anti-graft agency say di currencies wey dem seize include $73,000, £15,957 and 827,800 Saudi Riyals, and dem intercept dem during routine screening of passengers wey dey arrive between August 8 and 12.

U U Adamu, wey be acting customs area comptroller of di Kano/Jigawa command, talk say on August 8, customs officers intercept one unaccompanied Saudi Air luggage wey contain 827,800 Saudi Riyals and $53,300 wey dem hide inside shoe.

Four days later, officers also intercept one luggage wey belong to Yusuf, wey arrive on Ethiopian Airlines flight ET941.

He explain say secondary screening wey dem do using non-intrusive inspection technology reveal $20,000 and £15,957 wey dem hide inside sports shoes.

Adamu later hand over Yusuf and di recovered currencies to EFCC on behalf of NCS.