IMN members for Nigeria protest di killing of Iran supreme leader
Di peaceful protest bin start by 3pm from Fagge Central Mosque for Kano and end for IMN Islamic Centre for Kofar Waika, where dem bin hold speech and prayer.
Members of di Islamic Movement for Nigeria (IMN) bin carry do protest for Kano on Sunday over di mata of di killing of Iran Supreme Leader, Ali Khamenei.
Dia followers wey carry Iran flag and picture of Khamenei, bin walk through some parts of di city as dem dey show solidarity for di Iran leader wey reportedly die after di joint US and Israeli strike.
Di peaceful protest bin start by 3pm from Fagge Central Mosque and end for IMN Islamic Centre for Kofar Waika, where dem bin hold speech and prayer.
Di scholars wey talk for di gathering yarn about wetin dey happen for Middle East and how e fit affect di whole world. Dem also do special prayer for di people of Iran, dey beg God make He intervene as di wahala dey hot up.
Wen we call di Kano State Police spokesman, CSP Abdullahi Haruna, im say make we give am time go confirm di mata from di DPO for dat area. As of di time we dey write dis report, we neva hear any official word from dem.
Di protest bin dey peaceful sotay, no violence or wahala happen at all.