Russia confirm say dem help stop attack for Niger airport

Niger military government accuse Benin, France and Ivory Coast say na dem sponsor di attack for dia airport.

By
Di attack cause wahala for Niger / Reuters

Russia don confirm say im soldiers helep to stop one attack for di main airport for Niger capital, Niamey, wey happen last week. Di Islamic State (IS) group don claim say na dem do am.

Di military government for Niger don tok before say "Russian partners" helep dem to push back di attack wey no too dey common for di capital. For di attack, dem kill about 20 attackers and four Niger army soldiers wound.

One statement from Russian Foreign Ministry say, "Na by di joint work of di African Corps for Russian Ministry of Defence and Niger army wey dem stop di attack."

Di ministry add say, "Moscow dey seriously condemn dis latest bad attack from di extremists."

Niger military government accuse Benin, France and Ivory Coast say na dem sponsor di attack for di airport, wey also get military base inside.

Di head of di military government, Abdourahamane Tiani, bin later go visit di Russian military base to show "personal tank you for dia high-level professionalism," according to di ministry.

Russia no too dey talk about wetin im military dey do for di Sahel region, where Moscow don dey increase im influence.