Presido Tinubu of Nigeria say e ready for state police to stop insecurity palava

Tinubu tok dis matter when im host all di state governors for im house for Abuja, make dem together break fast for Ramadan and Lent period.

By
FILE PHOTO: Nigeria President Bola Tinubu / Reuters

Di President of Nigeria Bola Tinubu talk say state police go helep solve di insecuirty wey dey worry Nigeria, e still promise say all di promises wey im make before im become president for 2023, im go fulfill dem.

Tinubu tok dis matter when im host all di state governors for im house for Abuja, make dem together break fast for Ramadan and Lent period. Im tell di governors make dem try harder, make dem no forget di grassroots people wey dey suffer and sometimes dey lose hope.

Wetin Oga President tok: "Tonight, I bin host our state governors make we do interfaith fasting breaking, as Muslims dey observe Ramadan and Christians dey go through Lent.

"For dis holy period wey concern di two main religions for our country, we dey remember say apart from politics and policy, we be people wey get conscience.

"I thank di governors for wetin dem don do so far and for di outreach wey dem carry out dis holy month. But I still challenge dem make do more.

"Make we reach di young man wey feel say dem forget am. Make we help di woman wey dey carry her family with tired shoulder. Make we touch di grassroots communities where hope dey nearly finish. Development no suppose know religion, compassion no suppose know tribe, and opportunity no suppose know status.

"I don determine to rescue dis country. And as long as we dey work together to give hope to our citizens, di best dey come for Nigeria."