Bombs blow for northern Nigeria afta security forces chase away terrorists
Di Head of Operations of Federal Fire Service for Borno State, Mohammed Kafaran, confam say di bomb explode on Monday evening.
E still dey unclear how many pipo die, but plenty wound wen bomb explode for Monday Market for Maiduguri wey dey northern Nigerian Borno State.
We hear say di bombs go off at di same time around 7:02pm, few hours afta suspected Boko Haram terrorists attack three military positions for di state.
Di Head of Operations of Federal Fire Service for Borno State, Mohammed Kafaran, confam say di bomb explode on Monday evening. E talk say dem don send dem pipol go di place.
E talk: “Yes, bomb explode for Monday Market area near Elkanemi. We don send our team go dia check wetin dey happen. We go tell you soon.”
People wey see wetin happen talk say dem don carry plenty wounded pipol go hospital for treatment.
One eyewitness talk: “Dead body dey for ground, and plenty pipol wey get wound dem don rush go State Specialist Hospital for Maiduguri.”
Anoda resident, wey no want make we mention im name, tell us wetin happen wen di bomb explode.
“I just leave post office, dey go road wen I hear one big sound,” di resident talk.
As we dey write dis report, emergency workers don reach di bomb explosion place dey do rescue and check wetin happen.
Dis bomb explode come afta suspected Boko Haram terrorists on Monday morning attack three military positions for di state.
We hear say di terrorists attack Ajilari, Damboa, and Baga military posts at exactly 12:35am, but security pipol chase dem comot.XSE