Femi Fani-Kayode, Nigeria high commissioner to South Africa, talk say Pan-Africanism must replace di xenophobic sentiment for di country, wey don cause attacks on Nigerians and oda African nationals.
When e talk for di first Nigerian fair for di Nigerian consulate for Johannesburg on Saturday, Fani-Kayode remember di pan-African effort wey help South Africa get freedom from apartheid.
"E no be only black South African struggle. E be struggle wey every nation for Africa lead mainly by di frontline states and Nigeria, and every decent civilized nation for di world support," di high commissioner talk.
"Therefore, dem must never forget. And we must never forget di collective contribution wey we make to dia struggle.
"And when I come to dis beautiful country, and I see di joy, and I see di development, and I see di extraordinary infrastructure advancements wey dem make, and I see law and order, and I see all di wonderful things wey I see.
"I talk am bold, say we, from Nigeria, and truly di rest of Africa, get stake for dis, because we make contribution to wetin dem be today."
Fani-Kayode describe di xenophobic attacks for South Africa as "very retrograde and almost primitive sentiment".
"We must understand say di world dey come together as one, and we must stand together as one," e talk.
Di high commissioner note say Nigeria contribute no less than $61 billion for South Africa struggle against apartheid between 1960 and 1994 and send troops to di frontline states to fight against di apartheid regime.
"Nigeria do well well. Mandela tax — we impose tax on our own civil servants during di struggle, and dat money go di ANC," e add.
"Nigeria make sure say di children for school give up dia lunch, dia lunch money, and contribute to di South African struggle. Nigeria make sure say di United Nations, every international forum, we dey front line to make sure say dis country get freedom."
Fani-Kayode talk say South Africa must build bridge of brotherhood, friendship, and mutual respect with Nigeria and Africa to make di relationship better.
He describe di people wey dey do di xenophobic attacks as small minority wey look like say dem no understand di situation and "spirit of Afrophobia and xenophobia don catch dem".

























