| Pidgin
POLITICS
2 minit wey yu go read
Nigeria Elections: INEC don pick 17,676 polling units for mock exercise
Di commission talk say di exercise go cover two polling units for each of di 8,838 Registration Areas nationwide and e go run from 8:30 am to 2:30 pm.
Nigeria Elections: INEC don pick 17,676 polling units for mock exercise
Di real election go hapen for January / AFP (Wire)
 

Di Independent National Electoral Commission don pick 17,676 polling units across di kontri for dia nationwide mock accreditation and electronic result upload exercise wey dem schedule for Saturday, November 28, before di 2027 general elections.

Di commission talk say di exercise go cover two polling units for each of di 8,838 Registration Areas nationwide and e go run from 8:30 am to 2:30 pm.

INEC announce dis one for post on dia X handle on Monday, dey direct political parties, stakeholders and members of di public to dia website to see di list of selected polling units.

Di exercise aim na to test how di Bimodal Voter Accreditation System dey work, check accreditation procedures and find possible technical wahala before di 2027 general elections.

For dia announcement, di commission talk say, "INEC go conduct nationwide Mock Accreditation and Result Upload Exercise using di Bimodal Voter Accreditation System (BVAS) on Saturday, 28 November 2026, from 8:30 a.m. to 2:30 p.m.

"Di exercise dey designed to test BVAS functionality, check accreditation procedures and identify possible technical issues before di 2027 General Elections.

"E go happen for two Polling Units for each of di 8,838 Registration Areas nationwide."
INEC also provide link to di list of selected polling units, dey urge stakeholders and interested members of di public to check dia website for details.