One crisis of confidence dey brew inside di Economic Community of West African States (ECOWAS) Regional Competition Authority (ERCA) after one controversial proposal to introduce cap on merger notification fees across West Africa markets.
Nigeria Federal Competition and Consumer Protection Commission (FCCPC) na member of ERCA.
Wetin dey at stake na disagreement over modality for revenue allocation, regulatory jurisdiction and di level of institutional control wey ERCA headquarter for Gambia get over member states wey reach 12.
Di proposal, wey wan put cap at $500,000 for fees wey applicants go pay, go vest more control and resources for ERCA secretariat.
Members like Nigeria, Ghana, Sierra Leone and Liberia no comfortable with di idea.
Nigeria dey account for about 41 per cent of West Africa gross domestic product.
Because of dat, one uniform cap fit get disproportionate financial impact on Nigeria wey dey account for di overwhelming proportion of di region notifiable merger transactions, while e leave unresolved how dem go compensate national regulators for dia structural responsibilities.
Sources wey sabi di development confirm say things take dramatic turn two weeks ago when dem formally table di proposal during ERCA 13th statutory meeting for Conakry, Guinea.
"Dem email di memo to dat effect to us just ten minutes before di meeting start, for one manner wey look like ambush," one of di sources talk.
Di five countries call make dem stand down di matter so dem fit do due consultations with dia respective national institutions before dem take collective position.
Although di people wey dey push am argue say di cap go reduce compliance costs and make regional merger notifications more predictable for businesses, di opposition to di proposal centre on far-reaching financial and institutional implications.
One major concern be say regional merger filings fit displace existing national filing arrangements and di revenues wey dey attached to dem without clearly defined mechanism for sharing regulatory responsibilities, operational costs or proceeds between ERCA and domestic competition authorities.














