| Pidgin
WORLD
2 minit wey yu go read
Nigerian soldiers kill 14 suspected bandits for Katsina
Di incident also lead to di recovery of seven operational motorcycles wey belong to di suspected bandits.
Nigerian soldiers kill 14 suspected bandits for Katsina
Nigerian Army officers / AFP (Wire)
 

Troops of di Nigerian Army reportedly ambush and kill at least 14 suspected bandits for Gora community for Malumfashi Local Government Area of Katsina State.

Di incident wey happen late Tuesday night also lead to di recovery of seven operational motorcycles wey belong to di suspected bandits.

Dem learn say di incident happen when bandits in dia numbers try to carry out operation inside di community and areas around am.

Sources from di area tell journalists on Wednesday afternoon say di bandits, wey carry dangerous weapons, bin ride two-on-two on motorcycles come di area, and first try to lay ambush for di military operatives.

One of di sources wey prefer make dem no call im name because of security concerns talk say, "Di military operatives, wey know where di bandits dey, carry out counter-ambush, specifically between Gora and Gidan Barau communities, and di bandits get caught inside am.

"After di first ambush, some of di daredevil bandits decide to return to di scene with aim to recover di bodies of dia members, only for military to surprise dem in another ambush.

"At di end of di day, 14 of di bandits were killed, while seven motorcycles wey belong to di bandits were recovered by di troops."

Dem talk say before now, bandits dey operate almost every day for some of di rural communities, dey kidnap people and rustle domestic animals.

When dem contact am, di traditional ruler of Gora community, Alhaji Gora, as well as one traditional title holder for di council, Abdulaziz Sardauna, confirm di incident.