Morocco player Brahim Diaz don apologise for the Panenka penalty wey he miss wey make dem lose the Africa Cup of Nations title on Sunday. He talk say "my soul dey pain me" and he carry responsibility for the 1-0 defeat to Senegal for the final wey play for Rabat.
Morocco bin get penalty for the 98th minute after Diaz was hauled to ground by defender El Hadji Malick Diouf, incident wey cause unrest for the stands and on top the pitch.
The call come five minutes after dem disallow goal for the other end, and the decision, wey dem take after Video Assistant Referee (VAR) review, make some Senegal players comot the pitch in protest, with their coach Pape Bouna Thiaw encouraging them.
E take more than 14 minutes before calm return and the game resume, but Diaz then try one weak chipped penalty wey goalkeeper Edouard Mendy simply catch.
Na one of the last tins wey happen before the game go extra time, and Senegal clinch am thanks to Pape Gueye's superb winner.
"Yesterday I failed, and I take full responsibility and apologise with all my heart," Diaz write on Instagram.
"It will be hard for me to recover because this wound does not heal easily, but I will try. Not for myself, but for all who believed in me and for all who suffered with me," he added.
"I will keep going until someday I can give back all this love and be a pride for my Moroccan people," he said.
Top scorer
Diaz, 26, dey play for Real Madrid. He born for Malaga and he even get one cap for Spain before he change and start to play for Morocco in 2024.
He finish as the leading scorer for the 2025 Cup of Nations after he score one goal in each of Morocco's first five games for the tournament.
Morocco 50-year wait for the continental title go still continue at least until the 2027 tournament.
Panenka style, wey dem name after Czech footballer Antonin Panenka, na style wey player gently chip the ball into the centre of the goal rather than kick am hard to one side, dey hope say the keeper go commit and dive.











