27 Jenuwari 2026
Nigerian military talk say on Monday dem go try some offisa wey dem accuse of planning to remove President Bola Tinubu last year.
For October 2025, military talk say dem don arrest 16 officers over 'issues of indiscipline'.
"The Armed Forces of Nigeria (AFN) wan inform the general public say investigation into the matter don finish," Major General Samaila Uba, spokesperson for the Defence Headquarters, talk for a statement.
"The findings don show sey some officers get allegation say dem plot to overthrow the government," e talk.
"Those wey get case to answer go be formally arraigned before appropriate military judicial panel make dem face trial."
Dem no give any date.














