Di House of Representatives for Nigeria don yarn "oya!" to di goment. Dem tell di Federal Goment to use any and every diplomatic style wey dem get, to bring former Presido, Goodluck Jonathan, come back from Guinea Bissau.
Soldiers don do coup for Guinea Bissau, and di former Nigeria presido dey dat country wey dey bring uncertainty regarding im wellbeing.
Na one honourable, Hon. Julius Ihonvbere, bring dis matter for inside house. E talk say na urgent matta wey concern di whole country.
Him explain say our former Presido Jonathan dey trapped for dere. Jonathan go dere to dey watch di election make e fair, as e dey usually do for many oda countries. Na im dis coup just meet am for inside.
Hon. Ihonvbere talk say: "Na we be big country for Africa, and we get our former leaders wey dey alive and strong. Jonathan na one of dem, and na im be di first presido to concede election for Nigeria. Right now, im dey stuck for Guinea Bissau. E concern us, e important to everybody for dis country.
“So make goment do wetin dem fit do bring our former presido come back safe. Make dem bring any oda Nigerian wey dey dere too come back.,” na so e yarn.









