| Pidgin
POLITICS
2 minit wey yu go read
Tinubu go meet wit Starmer for UK as dem release programme for state visit
Di United Kingdom goment don release di programme for President Bola Tinubu dia state visit wey go happun from March 17 go reach 19.
Tinubu go meet wit Starmer for UK as dem release programme for state visit
Presido Bola Tinubu / AA
16 Machi 2026

Di United Kingdom goment don release di programme for President Bola Tinubu dia state visit wey go happun from March 17 go rish 19.

According to dia plan, dem go host di visit for Windsor Castle and e go include meetings, ceremonia events and dem go also meet wit some Nigerian pipo wey dey stay for UK.

Dem go begin prepare for di visit on March 17, wit security pipo go check everywhere, dem go close some roads and dem go do rehearsal for di procession bifor di president land.

Tinubu go officially arrive on March 18 and Prince William and im wife Catherine, Princess of Wales go welcome am.

Dem go do ceremonial welcome for Datchet road, wey go include playing of dia anthem and di guard go do inspection.

Di president go den enter carriage go Windsor Castle, wia King Charles III and Queen Camilla go receive am.

For anoda mata, di Nigerian goment tok say dem don catch one mining company, Jupiter Ltd, wey dey dey plan to "cast aspersions" on Nigeria during dis visit wey President Tinubu go do for UK, bikos of matter of mineral licences wey dem revoke.

Di Ministry of Solid Minerals Development tok say dis move wey dem dey plan na to make di Federal Goment reform for mining sector look bad and deceive di international community about di mata of di mineral licences wey dem revoke.

Dem tok say di company and dia associates dey plan to dey spread wetin dem call fake info about di Nigerian mining sector so dem fit spoil di goment reform wey dey happen.

For di statement wey dem release on Sunday by di Special Assistant on Media to di Minister of Solid Minerals Development, Segun Tomori, di ministry tok strong say di claims say Nigeria seize British lithium project wit armed guard na lie and dem dey mislead pipo.