Di number of people wey Lassa fever don kill for Nigeria don rise from 99 go 109 for just one week. Dis one pass di death wey dem record for di same period last year 2025.
Di country still dey see more health workers wey dey catch di disease.
According to di Nigeria Centre for Disease Control (NCDC), no be small thing – at least 37 health workers don catch Lassa fever for di first nine weeks of 2026. For one week alone, six health workers come down with am.
NCDC tok say, at least 18 states for Nigeria don record at least one confirmed case of Lassa fever.
Dem add say, "86 per cent of all confirmed Lassa fever cases come from five states: Bauchi, Ondo, Taraba, Benue and Edo."
NCDC still explain say, "Up till week 9 of 2026, 109 people don die from di disease, wey make di death rate be 23.2%. Dis one pass di death rate for di same time last year, wey be 18.7%."
"For di whole of 2026, 18 states don record Lassa fever cases for 69 local government areas."
"Eighty-six per cent of di confirmed cases come from five states: Bauchi (28%), Ondo (22%), Taraba (19%), Benue (9%) and Edo (8%). Di remaining 14% come from 13 oda states wey also get confirmed cases."
Di agency still yarn say di age group wey di disease dey hit pass na 21-30 years. For di confirmed cases, men get small pass women – di ratio na 1 man to 0.8 woman.
WORLD
2 minit wey yu go read
Lassa fever: Some states for Nigeria suffer pass as death toll reach 109
NCDC tok say, at least 18 states for Nigeria don record at least one confirmed case of Lassa fever.

Explore
















