| Pidgin
BIZNESS AN TEKNOLOJI
2 minit wey yu go read
Nigeria goment say dem no go accept cash for dia services again
Dis na part of bigger plan wey Nigeria get to modernize public finance, block all di holes wey money dey leak and stop corruption.
Nigeria goment say dem no go accept cash for dia services again
Nigeria goment want go cashless. / Reuters
9 Disemba 2025

From January 1, 2026, Nigerian goment don order say make any person no pay cash again for any goment service. Na only cashless policy dem go dey use collect all government money.

With this new change wey dem bring:

1. Dem go introduce one new e-receipt system wey dem call Federal Treasury eReceipt (FTeR) and everybody must use am.
2. Dem go fully start one platform wey dem call Revenue Optimisation (RevOp) Platform.

One document wey Federal Ministry of Finance for Abuja release today show say dis RevOp na one unified digital system wey go dey monitor, settle, and make government money better. E go concern all federal government agencies.

Di Office of di Accountant General of di Federation (OAGF) don release four circulars wey introduce big-big changes to how federal government dey collect money.

Di circulars na part of bigger plan wey Nigeria get to modernize public finance, block all di holes wey money dey leak, stop corruption, and make Nigeria money strong with technology.

Di document talk say, "From January 1, 2026, di Federal Treasury eReceipt (FTeR) go be di only valid and legal receipt wey government go accept for all transactions.

"This na big change for how Nigerians dey pay for goment services and how dem go check di payments.

"E concern all of us: citizens, business people, government offices, banks, and digital service providers."

Di Ministry talk say dem expect dis new policy to help goment save plenty money and even recover money wey before now dem don think say don lost.