About 3,122 pipo wey Boko Haram chase comot from dia house get approval on Monday to return to dia various communities for Gwoza and Bama for Borno state.
Di head of UNHCR office for Maroua for Cameroon, Madam Rudacogora Monique wey tok dis mata say everything don ready to return di 3,122 refugees to Nigeria with safety and respect.
According to News Agency of Nigeria (NAN), dem approve di refugees after joint screening by Federal Government of Nigeria, Cameroon Government, Borno State Government and UNHCR for Minawao camp for Maroua, Cameroon.
Madam Monique say di one week screening process don approve 306 pipo (71 households) wey come from Gwoza, and 2,816 pipo (486 households) from Bama.
Di diplomat promise say under di agreement between di three parties, dem go return di refugees safely and with respect from Minawao camp to Nigeria.
"I dey happy for di good work wey we dey do together with di pipo and government of Nigeria and Cameroon government," she tok.
WORLD
1 minit wey yu go read
UNHCR don okay 3,122 Nigerians wey dey Cameroon as refugees to return home
Dem approve di refugees after joint screening by Federal Government of Nigeria, Cameroon Government, Borno State Government and UNHCR.
Explore













