| Pidgin
WORLD
2 minit wey yu go read
President Tinubu say Nigeria go join hand with UK to fight insecurity
Di President yarn dis mata on Wednesday night during di state banquet wey King Charles III host for Windsor Castle.
President Tinubu say Nigeria go join hand with UK to fight insecurity
President of Nigeria state visit to di UK / Reuters
3 hours ago

President Bola Tinubu don tok say di collaboration between Nigeria and UK to fight insecurity still dey very important.

According to am, for im meeting with British Prime Minister Keir Starmer today (Thursday), im go discuss Nigeria counter-terrorism plans and di security challenges wey dey affect di region.

Di President yarn dis mata on Wednesday night during di state banquet wey King Charles III host for Windsor Castle.

Na di first time any Nigerian leader go address people for inside dat historic royal house for UK. Di dinner wey start by 9pm (local time) na part of di activities wey dem arrange for Tinubu state visit to UK.

For di security side, di President tok say im go yarn with Prime Minister Starmer about di fight against terrorism and how to handle instability for di region.

Im yarn say, "Our West African region get complex terrorism wahala wey root from Sahel. Nigeria carry heavy responsibility to help safeguard regional stability. For confronting these threats, partnership with UK still dey essential, and I dey look forward to my meeting with Prime Minister Keir Starmer tomorrow (today)."

Tinubu still remember say di UK give am refuge during di military dictatorship of former head of state, Gen. Sani Abacha. Im yarn say Metropolitan Police bin put im residence under surveillance to protect am from agents of di junta wey dey threaten am.

For appreciation, Tinubu tell King Charles say di support wey UK give Nigeria during "di dark years of military dictatorship" still dey dia heart and e dey very humbling. Im yarn say, "Your Majesty, I wish to express Nigeria deep gratitude to dis great nation for di refuge and support wey dem extend during di dark years of military dictatorship.

Like plenty Nigerians wey involve for di pro-democracy struggle, I find safety here, and I recall say my residence bin dey under Metropolitan Police surveillance for protection following threats from agents of di junta. Dat solidarity still remain for our collective memory, and e dey deeply humbling for me to stand before Your Majesty today as di President of a democratic Nigeria."