| Pidgin
WORLD
2 minit wey yu go read
King Charles go welcome Tinubu and im wife for Windsor Castle
UK go roll out red carpet for di President and im wife. Dem go carry dem go Windsor Castle inside horse carriage, and King Charles III and Queen Camilla go receive dem.
King Charles go welcome Tinubu and im wife for Windsor Castle
Di State visit na for two days / AP
14 hours ago

President Bola Ahmed Tinubu and di First Lady, Oluremi Tinubu, don land for United Kingdom (UK) yestarde for di two-day historic visit.
Dem go be guest of King Charles III.
Dem go also use di chance to sign bilateral agreements wit di British government wen dem meet Prime Minister Keir Starmer.

Di presidential aircraft touch down for Stansted Airport around 3:23 p.m. local time, wey mark di start of dis high-level diplomatic mata.
Di Special Adviser to di President on Media and Public Communication, Mr Sunday Dare, confirm dia arrival via post for im verified X handle.
"Timeline: 15:23PM. President Bola Tinubu and First Lady Oluremi Tinubu don touch down for Stansted Airport, United Kingdom, as historic visit begin."
Video wey im post show di presidential aircraft dey taxi comot for tarmac before di President and di First Lady comot from di plane.

Today, dem go roll out red carpet for di President and im wife. Dem go carry dem go Windsor Castle inside horse carriage, and King Charles III and Queen Camilla go receive dem.
Di King and di Queen go host di President and di First Lady to special exhibition from di Royal Collection wey get tins wey relate to Nigeria.
Di program also include private discussion between di monarch and di Nigerian leader, and dem go also join organisation wey dey do interfaith dialogue.
Dem go do ceremonial welcome for Datchet Road, wey go include di play of national anthems and di inspection of guard of honour.
Di program include formal reception, 21-gun salute and state luncheon for St George's Hall.

From dere, dem go move go London, where di President go lay wreath for di Cenotaph for Westminster before im go meet Prime Minister Starmer for 10 Downing Street for bilateral talk and working lunch.
Royal Family go host State Banquet for Buckingham Palace to honour President Tinubu and im delegation.

Dem expect say dis visit go end wit di signing of plenty agreements and memoranda of understanding between Nigeria and United Kingdom.
Di main areas wey dem go focus on for cooperation na trade and investment, energy transition, solid minerals development, and security collaboration.