| Pidgin
POLITICS
2 minit wey yu go read
Popular Nigerian pastor say Trump real target na Nigerian oil
Dis na di first time Bakare dey talk about di mata publicly since Trump again label Nigeria as country of particular concern for October 31st.
Popular Nigerian pastor say Trump real target na Nigerian oil
Nigeria get plenty oil / Reuters
1 Disemba 2025

Popular Nigerian pastor wey be Serving Overseer for Citadel Global Community Church, Tunde Bakare, tok say wetin make US President Donald Trump just label Nigeria as "Country of Particular Concern" and accuse say Christians dey suffer genocide na because Trump dey eye Nigeria oil.

Bakare wey talk dis tin during im State of di Nation Address for im church on Sunday tok say, Trump government dey look Nigeria oil and oda mineral resources and beta sectors like property business as main tins for im agenda.

E add say Trump still dey look Nigeria side well for di matter of new technology wey dey come up, wey im call main pillars for di America president im foreign and economic policy.

Dis na di first time Bakare dey talk about di mata publicly since Trump again label Nigeria as CPC for October 31 and make dat kain comment wey sweet for im mouth say im go attack terrorists for Nigeria "with guns-a-blazing, fast, vicious and sweet." Dat talk make President Bola Tinubu im government reply quick quick.

Bakare remember say shortly after Trump win di 2024 US election, im see vision wey di America president land for Sabo, Yaba for Lagos inside Air Force One plane, "wear Arabian thobe and ghutra" and announce, "We are here now."

E tok say di vision show say Trump go get "particular interest" for Nigeria wey concern Middle East politics, oil and gas, property business, and our technology sector wey dey grow.

Bakare tok, "E clear to us say President Donald Trump go get particular interest for Nigeria.

"Nigeria oil money and oda mineral resources go important well-well to Trump im presidency, and our part for di new technology chain too."

Im add say di Arabian cloth wey Trump wear for di vision mean say "religious wahala" fit happen if dem no handle di mata well.