25 Disemba 2025
Former Super Eagles midfielder and coach Sunday Oliseh don comot to defend im analysis of Nigeria performance against Tanzania during dia first match for Africa Cup of Nations.
Despite say dem win 2-1, Oliseh bin criticise parts of the performance wey make some Nigeria fans unhappy.
“Some pipo no understand say analyst gatz do im work well, no be say I no like Nigeria, I don serve di kontri football for 40 years now but my work now na to analyse wetin I see.” Di former Borrusia Dortmund player post for X.
Nigeria dey play Tunisia on Saturday as dem continue dia hunt for their fourth AFCON trophy for Morocco.

















