| Pidgin
WORLD
2 minit wey yu go read
US don begin investigate Nigeria and oda kontris over labour rights mata
Dis investigation wey dem start on March 12, 2026, go check weda Nigeria and di oda listed kontris don fail to introduce or effectively enforce ban on di importation of goods wey dem produce wit forced labour.
US don begin investigate Nigeria and oda kontris over labour rights mata
US go investigate forced work mata as e concern wetin dey enter dia kontri / Reuters
12 hours ago

Di United States goment don launch trade investigation against Nigeria and 59 oda kontris bikos of dia alleged failure to stop di importation of goods wey dem produce wit forced labour.

For di notice wey di Office of di United States Trade Representative release on Sunday, di US tok say dem don begin proper probe under Section 301 of di Trade Act of 1974 to check weda di trade practices of dis affected kontris "nor make sense or dey discriminatory" and weda dem dey affect American business.

Di General Counsel for di Office of di United States Trade Representative, Jennifer Thornton, sign di notice. Dis investigation wey dem start on March 12, 2026, go check weda Nigeria and di oda listed kontris don fail to introduce or effectively enforce ban on di importation of goods wey dem produce wit forced labour.

Di notice tok say, "Di Trade Representative dey begin investigations concerning di acts, policies, and practices of di economies wey dey Annex A of dis notice, related to dia failure to impose and effectively enforce prohibition on di importation of goods wey dem produce wit forced labour."

Nigeria dey among di 60 economies wey dem name for dis investigation, alongside kontris like China, India, Brazil, South Africa, di United Kingdom, Canada, and di European Union.

According to di USTR, dis probe na to find out weda di absence of effective import bans on forced-labour goods for dis economies dey create unfair trade conditions wey dey put American businesses at disadvantage.

Di agency tok say even though many kontris dey prohibit forced labour inside dia own kontri, di lack of strict controls on imports dey allow companies to continue sourcing products wey dem produce under exploitative conditions from global supply chains.